Wednesday 31 August 2011

¤~OFOFO~¤

KIDA KUDZ, dt ibadan boy wey win peak talent show 2 say make i tell unna say him don release 2 songs: se ti gbo ft OJB and also ko sere ni moscow ft OLAMIDE and also tell me say d video of se ti gbo was shot by dj tee and say ofofo go loud am wen e comot.. Dem don even sign am for coded tunes... But him no say make i tell unna dt one ooo bcos of thief people..# MARK ZUCKERBERG, owner of facebook tell me say make i tell unna say him wan launch FACEBOOK MUSIC SERVICE by september...# KAREN IGHO, winner of Big brother amplified say make i yarn u tori say all dos yansh and breast nude pictures wey dem dey show about her for websites na fake... She say na work of bad belle! I don knack u today ofofo like terry G dey knack u akpako.. Hope u don buy him album TERRY GZUZ... Na jus 150 naira ooo

No comments:

Post a Comment