Sunday 8 January 2012

Badluck egbere jolantern! Mr fuel subsidy!

Good people... Welcome to 2012... We don ready plenty plenty ofofo for unna! We no say since ds new year start we neva post any tangible thing! No vex for us! Na our president make u vex for! Him don remove fuel subsidy! U no say na fuel we dey take put for motor wey dey drive us about when we dey gather ofofo! Before now, most of unna no know wetin subsidy mean! No lie! If u no know, raise up ya hand! Make ofofo yarn u! Buh instead make pple talk about am responsibly! Na soo soo picture dem dey generate for their BB! I wan laff tire wen i see funny pix of ds fuel subsidy like *OMOGE WAA GBA PETROL!* and *BABA GOD PLS TURN WATER TO FUEL*... We go soon post some of dem! Abeg president badluck egbere jolantern, help us put ds subsidy ooo! Or else we go pray make god remove u as u take remove subsidy!

No comments:

Post a Comment