Wednesday 11 January 2012

OFOFO don come back again... Oyoyoyoyoyoyo

Hummmm... Unna go say i don start my wahala again... But no be my fault... Na the mouth-siasis sickness wey i get... My doctor don diagnose me of ofofoculosis... Him say na very bad disease wey dey make man dey talk talk... Soo, my mouth would never stop talking! Ds week ofofo don plenty well well... Soo, i don compile am for unna ofofo ambassadors... Shey u hear say TIWA SAVAGE fight ontop twitter... The thing wey apun be say one of her fans talk say for the pix wey she post say she no fine. Say na only ontop TV she dey fine. Heheheeheh... Na so fight start ooo! Me sef don dey think ds thing before... Her eyeballs dey always do me onekind! Hahaha*
shey unna even hear say BEYONCE and JAYZ pay the hospital wey dem born their pickin $1.3million! Haa.. Ds people get money ooo! Chai! But bad belle people dey carry rumour say the pickin name IVY BLUE CARTER means : Illuminati's Very Youngest Born Living Under Evil. Na unna sabi! Bad belle people!

NEW VIDEO's don comot ooo! Na dem be ds:
#FlAVOUR: nigeria ebezina (fuel subsidy removal cry)
#DAVIDO: damiduro...
#EEDRIS ABDULKAREEM: naija my country (jagajaga part 2)

buoda indirisu... U don start again abi... Dem go soon return u to exile... U don start ur jagajaga stuffs again! I pity u!
Winks* laters* muahhhhhhh*

No comments:

Post a Comment