Sunday 8 January 2012

Top artistes for 2011... Will u do more ds year??? 2012 is here! Yay yay yay!

Although some selebrity die (abi shey na celebrity) for ds year! we all know say 2011 was a good year for d entertainment industry... Wizkid blow. Dbanj sef turn bigdaddy. 2face sef dey try maintain boss level. We see tiwa savage. We see iceprince. MI release dt him film wey him call music... Heheheheh* we see BRYMO. We see many many people... And also dt small boy, DAVIDO sef dey ginjah people with him song... Mochedda head sef dey there* Skales sef do like say him wan blow* na boko haram no gree for am! Many many people! Boda 9ice we see u! W4 waa gba control joor! LYNXX utunu! 2shortz was not really short ds year*... Jessejags sef do him jagajaga! And my broda terry G was soo soo akpakolizing everybody! We jus dey knack knack and knack for dt year! Mohit try, choc city sef, hypertek we see unna, flytime promotion sef do show with psquare! Psquare sef release dt yeye mixtape... Sorry na album dem call am ooo! Them call am invasion con chop our money! God see u twins ooo! Ibeji oran! Jmartins sef jus no find beta person for nigeria do collabo.. Him first carry fally ipupa con join and wif cabo snoop! I no go lie unna, dt year was WIZBABA's year! Dt witchkid of a boy! Flavour nabania i no forget u... U jus dey do ya igbo thing jeje! U sha dey render chorus anyhow! Soundsultan, banky w, goldie, eldee, seriki, olamide, all of unna sef do ya own thing! We love u! Now, ds is 2012! Will u do something better??? Or we shud expect new crop of artistes to sweep u guys off d scene! Hehhhhhhnnnnnnn!

No comments:

Post a Comment